39-year-old Chris Imumolen win Accord Party presidential ticket

Christopher Imumolen don win Accord Party presidential ticket for 2023 elections.

The party declare the thirty-nine-year-old Imumolen winner for their presidential primary election wey happen for inside Abuja.

Imumolen win the primary by voice vote after the second person wey dey follow am contest step down.

Accord Party national chairmo, Muhammad Nalado, tok say as the party elect Imumolen, that one na sign of victory.

Imomolen for him acceptance speech, tok say him de contest for president to take address leadership challenges wey de face Nigeria.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x