Di Federal Competition and Consumer Protection Commission don blame market cartels for di high costs of goods and services across Naija.
FCCPC’s Chief Executive Office, TUNJI BELLO, tok say di market cartels na them dey commit crime of manipulation of prices of commodities for markets across we country.
TUNJI BELLO, wey bin dey tok with people for stakeholders’ engagement for Uyo, Akwa Ibom State, say di price fixing dey common with poultry farmers, and na di major players dey cause am.
BELLO say d big poultry farmers dey use dia big money power hijack di poultry farmers’ association, then come begin use am to dey dictate prices of products, and that one dey destroy the di free market principles.