ADC nominate Tonto Dikeh as their Deputy Governorship candidate for Rivers State

African Democratic Congress governorship candidate for Rivers State wey be Tonte Ibraye don nominate popular Nollywood Actress, Tonto Dikeh as him Deputy Governorship candidate for the 2023 Rivers State governorship election.

The actress who tok this one for one statement on top Instagram, tell Ibraye say belle sweet am well well as him take nominate am on top the position.

Dikeh say she de look forward to work with Ibraye to take make sure say women dem get mouth for inside politics, say small businesses get government support plus say make traditional institutions dey strong for inside Rivers State.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x