APC don start their presidential campaign for Jos   

All Progressives Congress Presidential candidate Bola Tinubu don promise Nigerians say hope don come back.

Tinubu wey make this promise for the APC presidential campaign flag-off for Rawang Pam Township Stadium for Jos, Plateau State, tok say Nigeria go better.

The former Lagos State Governor still promise say him go build on top Oga Presido Muhammadu Buhari achievements for the last seven years.

Oga Presido Muhammadu Buhari, Senate Presido Ahmed Lawan, some APC governors plus other party members attend the flag-off.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x