Atiku and Obi attend NBA Annual General Conference, but Tinubu no show

Atiku Abubakar and Peter Obi don attend Nigeria Bar Association General Conference, but Tinubu no show.

APC presidential candidate, Bola Tinubu send him running-mate, Kashim Shettima make him represent am for the NBA Conference wey shele for Victoria Island.

When Shettima come for stage to tok, him tok say APC government wey Tinubu go lead go transform Nigeria like Lagos and Borno states.

For him own side, Atiku Abubakar share him plans with lawyers on top matter wey concern, unity, security, economy, education plus make power reach grassroots people dem.

Peter Obi wey still yarn him own mind, say this 2023 elections wey de come so, no go concern connections, tribe, or religion, but sabyness plus character and strong mind to take deliver.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x