Candidates for Osun Governorship election don sign peace agreement

Candidates for the Osun state Governorship don sign peace agreement ahead of Saturday election.

The signing of the peace agreement na the highpoint for one stakeholders’ meeting wey the National Peace Committee wey former Military Head of State, General Abdulsalam Abubakar de lead.

General Abubakar no de present for the event wey shele for Osogbo, Osun state capital, but second person for the NPC, Reverend Father Matthew Hassan Kukah dey on ground to coordinate activity.

INEC Chairmo, Professor Mahmood Yakubu wey come the event, come de beg the candidates dem say make dem obey all the conditions wey de inside the peace agreement.

On top him own part, Ooni of Ife, Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi still remind politicians say, na the people still get power pass.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x