News

Rivers police command arrest DPO killers
Rivers police command arrest DPO killers

Rivers State Police Command don arrest six suspects on top the killing of one Divisional Police Officer wey de charge of Ahoada Police Division, SP Bako Angbashim. The command arrest the suspects dem for one operation for Odumude community inside Ahoada East Local Government Area wey the state Commissioner of Police, Nwonyi Emeka lead. The command’s Tok…

Osimhen score hat-trick as Nigeria thrash Sao Tome and Principe 6-0 for Nations Cup qualifying game
Osimhen score hat-trick as Nigeria thrash Sao Tome and Principe 6-0 for Nations Cup qualifying game

Victor Osimhen score hat-trick as Nigeria thrash Sao Tome and Principe 6-0 for Nations Cup qualifying game for Godswill Akpabio Stadium for inside Uyo, Akwa Ibom State. That Super Eagles win ensure say, Nigeria win their group with 15 points. Osimhen goal na 10 for AFCON qualifier and that one fit make the highest goal scorers for…

Banks open for Lagos States as NLC dey start strike today
Banks open for Lagos States as NLC dey start strike today

Banks for Victoria Island inside Lagos State open for business, even though di Nigeria Labour Congress declare two-day warning strike wey start today. Lasgidi FM Correspondent Azuka Onwuzor wey visit some banks for Ajose Adeogun, Adetokunbo Ademola and Ligali Ayorinde streets, observed se customers dey go in and out of di banking halls. E be like se…

Femi Falana tok say no election don attract attention pass 2023 presidential election
Femi Falana tok say no election don attract attention pass 2023 presidential election

Human rights lawyer, Femi Falana tok say no election don attract attention pass 2023 presidential election since Nigeria get independence over sixty years ago. Falana still tok say petitions wey follow last general election to put judiciary for blackmail plus intimidation wey we never see for Nigeria history. The Senior Advocate of Nigeria still warn people wey…

Presidency tok say Presidential Election Petition Tribunal judgement no de worry am
Presidency tok say Presidential Election Petition Tribunal judgement no de worry am

The Presidency don tok say Presidential Election Petition Tribunal judgement no de worry am. President tok tok person wey be Ajuri Ngelale tok say Oga Presido Tinubu no threaten   tribunal’s judges as some people de allegiate. Ngelale tok this one as him de answer question for television programme wey we monitor for Lagos.

Military don warn against public protests
Military don warn against public protests

The Military don warn against public protests as Presidential Election Petition Tribunal wey de sit Abuja prepare to deliver judgment for the petition wey de challenge Oga Presido Bola Tinubu as Presido. The Director on top Defence Information, Brigadier General Tukur Gusau who give warning for statement, advise anybody wey de plan to cause violence for the…

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x