Victor Osimhen score hat-trick as Nigeria thrash Sao Tome and Principe 6-0 for Nations Cup qualifying game for Godswill Akpabio Stadium for inside Uyo, Akwa Ibom State. That Super Eagles win ensure say, Nigeria win their group with 15 points. Osimhen goal na 10 for AFCON qualifier and that one fit make the highest goal scorers for…
The United Nations Human Rights Office don throw support give Spanish female footballer, Jenni Hermoso after Spanish Football Federation presido, Luis Rubiales kiss the player for mouth. The UN body tok for statement say, everybody get responsibility to condemn sexual harassment plus abuse. Hermoso tok say she no give Luis permit to kiss am for Spain’s Women’s…
First Lady, Oluremi Tinubu don receive Super Falcons for Presidential Vila inside Abuja. Senator Oluremi Tinubu tell the players dem say, de do well for FIFA Women’s World Cup wey Australia and New Zealand join hand together host. The First Lady still tell the players make they see themselves as people wey other Nigerians fit copy.
Sporting Lagos Football Club don win the 2023 Naija Super Eight championship. Sporting Lagos beat Remo Stars four-two for penalties to take win the tournament for the Mobolaji Johnson Arena, Lagos.
World record holder, Tobi Amusan, don win the one hundred metre hurdles for the Diamond League inside Poland. The Nigerian athlete still win her season’s best for the Silesia Diamond League for twelve-three-four seconds. Amusan finished the run after Kendra Harrison and Nia Ali, from USA, wey finished second and third.
Napoli of Italy don dey consider Paris Saint-Germain one hundred and twenty million euro bid for Nigerian striker, Victor Osimhen. Napoli Presido, Aurelio de get hope to jack up to one hundred and fifty million euros through Osimhen but no oda club dey willing to offer more dan PSG. Other clubs that had shown interest in signing…