CBN don tok say dem no go go back for the new cash withdrawal policy

The Central Bank of Nigeria don tok say dem no go go back for the new cash withdrawal policy upon say many Nigerians no gree with the policy.

Senate and the House of Representatives don still show concern on top the new policy and come still ask CBN make dem provide more informate on top the matter.

However, CBN Governor, Godwin Emefiele, say the policy go go ahead after him meet Oga Presido Muhammadu Buhari for him village for Daura, Katsina State.

Emefiele wey follow tori people tok for Daura say the limit on top cash withdrawal no be to offend anyone.

The CBN governor come still beg Nigerians make dem support the policy just as him de make promise say, the bank go adjust the policy if e de necessary.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x