Charly Boy waka comot for Anambra State Peace Committee

Popular Nigerian entertainer, Charles Oputa, wey everybody know as Charly Boy or Area Father, don comot for the Peace Committee wey Anambra State Governor, Professor Charles Soludo set up.

Charly Boy, wey confirm this development to Lasgidi FM News Desk for telephone interview, tok say him de aware say follow musician, Onyeka Onwenu don comot for the committee.

Charly Boy tok say him comot for the committee because say Anambra State Government no de serious for the job wey they want make the committee do.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x