Court sentence 3 people to death by hanging sake of say dem kill Fasoranti daughter

Ondo State High Court inside Akure don sentence 3 people to death by hanging sake of say dem kill Pa Reuben Fasoranti daughter wey her name na Olufunke Olakunrin.

Though na four people dem accuse for the crime, the trial judge wey be Justice William Olamide discharge plus acquit one of them.

The lawyer wey de represent the offenders tok say him go study the judgement to take see if him go fit file appeal.

On top him own part, the Attorney General and Commissioner for Justice in Ondo State, Charles Titiloye, say the court judgement sweet him belle well well.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x