Lagos State Special Offences Court don sentence one notorious kidnapper wey him name na Chukwudumeme Onwuamadike but people know am as Evans to twenty-one-years for prison after him don dey on trial for more than eight years.
Justice Oluwatoyin Taiwo for the ruling, say Evans plus him partner for crime wey be Victor Aduba de guilty for kidnapping.
Lagos State Government carry Evans and Aduba go the Court because dem kidnap one Sylvanus Ahanonu Hafia for Kara Street inside Amuwo Odofin Local Government Area for the state and come still dey demand make dem pay dem two million US dollars ransom.
This latest judgement na the second one wey Evans don get, you fit still remember say Justice Hakeem Oshodi been sentence the kidnapper plus him two other partners for crime to life imprisonment sake of say them kidnap one Donatus Dunu wey be the Managing Director for one pharmaceutical company.