Delta State Police Command debunk snake bite game among primary and secondary students as cult initiation

The Delta Police Command don debunk the snake bite game wey human right activists, Harrison Gwamnishu  discover among primary and secondary school students for Delta State as cult intiation no be true.

Snake bite na game wey human rights activist, Harrison Gwamnishu find out se na inititiation among primary and secondary school students for Asaba, Delta State.

According to Harrison the children dey spread am among themselves and dem dey believe se group wey get the mark fit threaten teacher wey discipline dem.

The human rights activist claim se him and him team discover se na sixty-one students of one private school around 74 area inside Asaba get the same mark.

Harrison tell our crime tori persin Najite Atirene se him don report the matter to the Ministry of Education for Asaba, him allege se dem dey use white paper tek scratch the back of hand until blood comot wey go later become mark for the back of their palm.

Harrison wey tok se him allow one of the student do the snake bite for him hand yarn se him dey receive threat calls from pipu se him don expose dem.

Him dey advise parents and guidance to put eye for their pikin and dey urge the police to do thorough investigation into the snake bite game.

However, the Delta State spokesman, DSP Bright Edafe tell our crime tori persin se the narrative wey Harrison dey show for social media dey mislead.

DSP Edafe tok se the command do their investigation and find out se the snake bite na game wey dey common among chidren.

According to DSP Edafe, the mark no be cult initiation but na harmless trend among school children.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x