DSS tok se make pipu wey no get business for Eagle square no near there on Monday next week.

Department of State Services don give another warning se some pipu dey plan to scatter the presidential inauguration ceremony on Monday next week.

This na the third warning from DSS since dem announce the result of the presidential election in favour of APC Bola Ahmed Tinubu and him running-mate, Kashim Shettima.

DSS tok tok persin, Peter Afunanya, tok se pipu wey dey against the inauguration of the President-Elect and the Vice President-Elect wan create panic and put fear among members of the public.

DSS tok tok persin tok se make media representatives and pipu wey go attend the event follow security and civil protocols during the events.

Him still advise members of the public to comot mind from fake news and make dem no raise false alarm or spread one-sided reports wey fit cause division and tension for we countri.

The tok tok persin com warn pipu wey no go get authority or pipu wey dem no accredit not to come near Eagle Square for Abuja during the ceremony next week Monday.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x