Loading Events

« All Events

  • This event has passed.

APC DEY FEAR SE DEM FIT LOSE MAJOR CONTROL FOR INSIDE NATIONAL ASSEMBLY

June 23, 2022 @ 8:00 am - 5:00 pm

Di National Chairmo of di All Progressives Congress, ABDULLAHI ADAMU, don dey worry se the party fit lose majority control for inside National Assembly.

Dis na becos of di way wen APC lawmakers for Senate and the House of Representatives just dey port commot from di party, ahead of di 2023 general elections.

Two APC Senators – AHMED KEITA of Katsina north and FRANCIS ALIMIKHENA of Edo North don already port commot and dem say up to twenty others dey plan to port go opposition party.

Afta one closed-door meeting with APC members for di National Assembly, the party National Chairmo tok se dem no fit do anything about di way pipu tek dey rush port.

Details

Date:
June 23, 2022
Time:
8:00 am - 5:00 pm

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x