Federal Government tell Facebook make dem ban IPOB on top their platform

Federal Government don ask Facebook make dem stop the Indigenous People of Biafra make dem de drop their messages through its platform.

Oga Minister for Information and Culture, Lai Mohammed, claim say IPOB de use Facebook plus including other social media platforms to take spread messages wey de promote violence and ethnic hatred for inside Nigeria.

Lai Mohammed been tell Facebook officials for one meeting for Abuja say Federal Government don ban IPOB for inside Nigeria and still brand them as terrorist group.

Mohammed tok say Facebook no get reason to take de allow IPOB use their platform to take spread their messages.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x