FG launch new Nigerian National Petroleum Company Limited

The Federal Government don launch new Nigerian National Petroleum Company Limited.

NNPC Limited been come after government unbundle the former Nigerian National Petroleum Corporation after the National Assembly pass Petroleum Industry Act.

Oga Presido Muhammadu Buhari join other top-top people for the unveiling ceremony wey shele for inside Abuja and still feature performances plus tok tok.

Oga Presido Buhari for the event come de tok say him government de put eye for ground for mater wey concern how petroleum industry go fit grow for Nigeria.

For him presentation, the Minister for State for Petroleum Resource, wey be Timipre Sylva, come tok say na big achievement as National Assembly sign the Petroleum Industry Act.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x