Fire de burn for Ijora Olopa Frozen Food Market.
Lagos State Emergency Management Agency wey confirm the matter for one update, say the market dey for Eko under bridge.
LASEMA Oga wey be Olufemi Oke-Osanyintolu say though no know the cause of the fire, but all the market under the bridge burn.
Oke-Osanyintolu come still tok say nobody die or woundjure for the incident.