ICPC don re-arrest former JAMB registrar, Adedibu Ojerinde   

Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission don re-arrest former JAMB registrar, Professor Adedibu Ojerinde.

ICPC tok tok person Azuka Ogugua, wey confirm Professor Ojerinde arrest, say the arrest na based warrant wey dem collect from Federal High Court for Abuja.

Ogugua for the statement still tok say ICPC arrest Professor Ojerinde base on new evidence wey dem discover as dem de investigate Ojerinde say him divert money wey belong to JAMB.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x