INEC tok say dem no go add another two months for political parties to take do their primaries

Independent National Electoral Commission don tok say dem no go add another two months for political parties to take do their primaries

INEC Chairmo, Professor Mahmoud Yakubu tok say June 3, 2022 still be the deadline wey political parties get to take conduct their primary and still submit their candidates lists.

Professor Yakubu tok this one for one meeting wey him be get with oga dem for Inter-Party Advisory Council.

IPAC National Chairmo, Yabagi Yusuf Sani, been beg INEC Chairmo say make dem add another extra two months make the political parties for get extra time prepare for the primary.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x