Lagos Assembly say dem want better welfare plus respect for traditional rulers

Lawmakers for the Lagos State House of Assembly say dem want better welfare plus respect for traditional rulers.

The house still tell the Lagos state government say make dem de honour traditional rulers before and after dem die.

This one so de happen after the lawmaker wey de represent Mushin Constituency Two wey be Olawale Olayiwola raise the matter for plenary.

Olayiwola say traditional rulers for we country no de get the kind respect wey Queen Elizabeth been get during her lifetime and up to the time wey she die.

Speaker Mudashiru Obasa for him side come still tok say e no go dey easy to recognize all traditional rulers, but e de important make dem de celebrate first class traditional rulers when dem de alive and even when dem don die.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x