Lagos State go hold APC Presidential Campaign on Saturday.

On Saturday dis week go be Lagos turn to host di presidential campaign of di All-Progressives Congress.

Already, plans don set for di campaign wey dem go hold for Teslim Balogun Stadium, for Surulere and dem go standby security men plus arrange how motor go move for di area.

Senator GANIYU OLARENWAJU SOLOMON, wey be di Chairmo of di Local Organising Committee tok se the rally go be like carnival.

The National Youth Leader of di APC, DAYO ISREAL dey ginger se Lagos State remain major stronghold of em party.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x