Lagos State Government don destroy okada wey taskforce been seize

Lagos State Government don begin dey destroy okada wey taskforce been seize as the government don tok say dem go ban okada for some parts inside the state.

Our own Najite Atirene, who de for the place wey dem wan destroy the okadas, say the task force say dem go destroy over seven thousand okada.

The Taskforce Commander, wey be CSP Shola Jejeloye tell Najite say dem never get wahala as dem de enforce the ban for Okada riders inside the state.

Lagos State Commissioner for Information plus Strategy, Gbenga Omotoso who de for the site wey dem de destroy the okadas, tell people wey dey ride okada say make dem register with Lagos State Government so make them fit get work with Lagos State Government.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x