Lebanese man face manslaughter charges on top reckless driving for inside Lagos

One Lebanese man, John Greg go face manslaughter charges on top reckless driving for inside Lagos State.

This one na because say the victim of the accident wey happen for Sanusi Fafunwa Street, Omotola Akinsanya don die as she de receive treatment for hospital.

The tok tok person for the Lagos State Police Command, wey be Benjamin Hundeyin, tell tori people say dem go change the first charge wey dem been file against John Greg to take show this new development.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x