LONDON METROPOLITAN POLICE CATCH IKE EKEWEREMADU AND HIM WIFE FOR HUMAN TRAFFICKING AND ORGAN HARVESTING

UK Police don arrest and charge two Nigerians, IKE EKWEREMADU and him wife, BEATRICE NWANNEKA EKWEREMADU, for human trafficking and organ harvesting.

The Metropolitan Police arrest plus detain the EKWEREMADS, wey bi sixty and fifty-five year old for London.

The Metropolitan Police tok se the Specialist Crime team bin don start to dey investigate their case since May di year, following by allegation of modern slavery.

Meanwhile; dem arrest IKE and BEATRICE EKWEREMADU, on Tuesday for the London Heathrow airport, and dem appeared for Uxbridge Magistrate Court.

Reports from di UK dey show se dem deny di husband and wife bail and dem go for custody until July 7, 2022, di day wey dem adjourned to mata to.

Dem reveal se the victim of the alleged crime na fifteen-year-old boy wey dem carry from Lagos to UK, and di Metropolitan Police dey safeguard the pikin.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x