Central Bank of Nigeria don increase the intereat rate of the Monetary Policy Committee to eighteen-point-five percent.
The MPC for hin last meeting adopt the new rate increase by five percent compare to the previous rate wey stand for eighteen percent.
This na the third time wey the CBN dey jack up the MPR wia dem dey use take dey measure the interest rate.
CBN Governor, GODWIN EMEFIELE, announce the new rate for Abuja wen him dey address tori pipu when dem finish the MPC meeting for the month of May.