NECO don shift 2022 National Common Entrance Examination for Federal Unity Colleges   

National Examinations Council don shift the date for 2022 National Common Entrance Examination wey dem go take admit students into Federal Unity Colleges.

NECO bin fix the exam for April 23 to May 7, 2022, but dem never announce new date.

The person wey de head NECO division for Information and Public Relations, Azeez Sani na him announce the delay for statement.

SANI tok say dem postpone the exam because sey plenty students no register.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x