Oga Presido Buhari don deny say him approve automatic weapons for security agencies wey state government get

Oga Presido Buhari don deny say him approve automatic weapons for security agencies wey state government get.

Presido Buhari deny this one for statement wey circulate for the State House Twitter handle on top reaction say Ondo State Governor Rotimi Akeredolu de accuse government say dem de bias.

Governor Akeredolu for one recent statement accuse Federal Government say dem approve automatic weapons for men of Katsina State security agency, but no gree do the same for Operation Amotekun wey de for Southwest.

The Presidency tok say no state for we country, including Oga Presido State wey be Katsina get power to buy automatic weapons for their security agencies.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x