Oga Presido Buhari don promise to tackle wahala wey de face businesses and investments inside Nigeria

Oga Presido Muhammadu Buhari don promise to tackle all the wahala wey de affect businesses and investments inside Nigeria

Presido Buhari tok this one when him receive the Chairmo of Dangote Group, Aliko Dangote for the Presidential Villa for Abuja.

Oga Presido come advice business pipo make dem use their resources and ideas take create employment plus tackle poverty.

Aliko Dangote on him own part come thank Oga Presido say him do well say him introduce policies wey don help improve businesses for we country.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x