Oga Presido Buhari go make national broadcast on Sunday

Oga Presido Muhammadu Buhari go make national broadcast on Sunday as part of activities to take celebrate this year Democracy Day.

Minister for Information plus Culture, wey be Lai Mohammed tok say before that broadcast, one public lecture go shele for National Mosque on Friday plus Jumat prayers that same day and still for dat same venue.

Mohammed still tok say one special church service go still shele for the National Christian Centre on Sunday to take celebrate the day.

Him come still add say the celebration go still continue till Monday wey one parade go happen for Eagle Square inside Abuja.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x