Oga Presido Buhari tell APC members say make dem de united

Oga Presido Muhammadu Buhari don tell APC members say make dem de united and avoid unnecessary wahala.

Oga Presido Buhari wey give the charge for him address for the Eagle Square wey be the venue for the APC special convention to take elect the party presidential candidate for 2023 general election , tok say the big job wey de ahead for the National Working Committee na make dem continue to de promote unity among members.

The Presido wey follow delegates tok before the voting exercise, come beg party officials say make dem follow due process and obey all laws and regulations to take elect the party presidential flagbearer.

Him still tok say APC presidential flag bearer must be person wey de knowledgeable and get strong belief for the unity of Nigeria and still get character to move the country forward.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x