Oga Presido Muhammadu Buhari Don Nominate Lauretta Onochie as Chairmo of NDDC

Presido MUHAMMADU BUHARI don send di name of one of his social media aides, LAURETTA ONOCHIE, go Senate for confirmation as Chairmo of di Niger Delta Development Commission.

ONOCHIE name Oga Presido write am inside letter wey em send go give di Senate Presido, AHMED LAWAN, as dem read for di Red Chambers during plenary.

Di names of fourteen oda nominees follow dey inside letter for confirmation of their appointment as members of di Board of the NDDC.

The last time wey Oga Presido BUHARI sent names of nominees for di NDDC Board to di Senate for confirmation na for 2021.

Meanwhile, some stakeholders for the Niger Delta region don welcome di move to set up di Board of the Niger Delta Development Commission.

Dem se nomination of LAURETTA ONOCHIE as Chairmo of di NDDC dey in line wit di provision of rotation among di nine NDDC states.

One Niger Delta activist, Comrade PAT OBIENE, wey follow Lasgidi FM UKPAI EZERA yarn for telephone interview tok se ONOCHIE political exposure, due to her strong links to di governing All Progressives Congress, fit be major challenge for her nomination.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x