Oga Presido Muhammadu Buhari don visit Kuje Prison for Abuja

Oga Presido Muhammadu Buhari don visit Kuje Prison for Abuja, after terrorists attack the prison.

Oga Presido Buhari reach Kuje prison this afternoon to see the damages wey the terrorists dem cause.

As Oga Presido dey move round the prison, him see many motor wey burn, walls wey break plus including barbed wire wey the terrorists dem bomb.

The Presido later comot for the place as him no follow tori people tok as him move go airport for him waka to Senegal.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x