Ohanaeze Ndigbo say dem no happy with Oga Presido Buhari comment on top gbege for Southeast

Ohanaeze Ndigbo Worldwide don tok say dem no happy with Oga Presido Muhammadu Buhari comment on top gbege wey dey shele for Southeast.

The igbo body tok say e de wrong for Oga Presido Buhari to suggest say non-indigenes plus security officials na the only people wey men wey carry gun de kill for the zone.

Ohanaeze Ndigbo tok say Oga Presido Buhari comment fit poison people mind.

Ohanaeze Presido George Obiozor for one statement wey the Igbo body National Publicity Secretary wey be Alex Ogbonnia sign, accuse Federal Government say dem de cause violence for Southeast and still de blame the people wey the gbege de affect

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x