PDP don postpone their presidential rallies because of Atiku US waka

Peoples Democratic Party Presidential Campaign Organisation don postpone their rallies sake of say their presidential candidate wey be Atiku Abubakar travel go United States for political campaign plus meeting.

The PDP Campaign Director for Field Operations, Umar Bature, wey tok this one for one statement, still tok say their presidential rallies wey dem be plan say e go hold for Ondo, Kebbi, Ekiti and Bayelsa States no go happen again as dem take plan am.

Bature come still add say, dem go announce new dates when dem fix am.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x