Peter Obi don meet Nyesom Wike, Mimiko plus other people dem

The presidential candidate for Labour Party, Peter Obi, don still meet Rivers State Governor, Nyesom Wike and former governor of Ondo State wey be Olusegun Mimiko.

Former Cross River State Governor, Donald Duke; Benue State Governor, Samuel Ortom; Abia State Governor, Okezie Ikpeazu, Gombe State former governor, Ibrahim Dankwambo still attend the meeting wey take place for Governor Wike’s private house for Port Harcourt wey be the Rivers State capital.

Olusegun Mimiko wey share the picture of that meeting for Twitter, no tok any reason why dem meet.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x