Police don arrest mama wey dey brutalize her two children.

Di Lagos State Police Command don dey investigate brutal assault against two children by their biological mama for di Egbeda Idimu area of Lagos State.

Di children na two and five years for age and their mama Busola Oyediran leave their papa com dey live wit anoda man wey be Akebiara Emmanuel.

Lasgidi FM News Desk gather se Oyediran dey always beat her children and plenti mark full their body.

Di Lagos State Police tok tok persin Benjamin Hundeyin for telephone interview wit our crime correspondent Najite Atirene tok se na neighbor by force rescue di children, carry go hospital wey dem tek give dem medical care.

Hundeyin still tok se wen dem dey question Oyediran she come dey claim se di marks and injuries wey dey di children body na from okada accident.

He plus tok se police don hold their mama Oyediran wit em living partner Emmanuel for Idimu Police Division and dem go transfer dem go Police headquarters Ikeja for further investigations while police don establish contact wit di children biological papa so dat em go fit take care of dem.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x