Police Oga – IGP Usman Alkali Baba don order se mek dem investigate Portable

The Inspector General of Police, USMAN ALKALI BABA, don give order to investigate controversial street singer, HABEEB OKIKIOLU, wey we sabi as PORTABLE.

Dis na sake of se PORTABLE dey boast for online video se na him be di oga of di notorious criminal cult group wey dem dey call One Million Boys, wey dey operate for different parts of Lagos State.

Di Force tok tok persin, MUYIWA ADEJOBI, confirmed di directive of di Inspector General for inside one  statement to tori pipu.

ADEJOBI tok se dem dey expect se di Lagos State Police Command go tek di necessary legal action wey dey in line wit di mandate of di police to identify sponsors of cult groups and to end di activities of di criminals.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x