Two Nollywood Actresses – Sola Onayiga, Ada Ameh don die.

The Naija movie industry don dey cry over the deaths of Nollywood actresses, SOLA AWOJOBI ONAYIGA and ADA AMEH.

ONAYIGA died early mo mo today afta she don spend like two weeks for Intensive Care Unit inside di Lagos State University Teaching Hospital.

ONAYIGA dey popular for her cooking practical role wey sehe dey act for popular oldskool television drama – ‘Fuji House of Commotion’.

Anoda Nollywood actress; ADA AMEH wey dey popular for television series “The Johnsons”, as AMU sef died on Sunday night.

According by reports dem tok se she bin dey visit persin for Warri Delta State wey she slump and dem rush am go hospital where she die.

ADA AMEH before she die, she bin dey suffer from depppression since her pikin dey for 2020 and seven of her family members too don die before.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x