UNITED STATES MISSION TO NIGERIA DON THROWAY SALUTE GIVE INEC FOR EKITI STATE GOVERNORSHIP ELECTION

 

Di United States Mission to Nigeria don praise di Independent National Electoral Commission on top di way dem tek conduct Ekiti State governorship election.

 

Di US Mission note se dem notice se di technical improvement dey for the bi-modal voter accreditation system.

 

For inside statement ontop how dem tek asses di election, di US Mission slap hand give di people of Ekiti State ontop di way wey dem peacefully conduct di election last Saturday, June 18, 2022.

 

Dem still hail security personnel, wey dem tok se helep to achieve a secure election wit credible result.

 

According by di statement from di Public Affairs Section of the US Consulate for inside Lagos; the US Mission come dey encourage all Nigerian citizens to go register to vote for di national elections wey dey come.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x