Raphael Onyedika don give Nigeria better morale as dem dey prepare for dia 2026 FIFA World Cup qualifiers against Rwanda and Zimbabwe. Di defensive midfielder bin get injury wey make am comot for Club Brugge Belgian league match against Standard Liege last month.
Because of di injury, dem no put am for squad wey win KAA Gent for Belgian Pro League last weekend. But di 23-year-old don return at di right time and e don enter Club Brugge squad for dia UEFA Champions League Round of 16 first-leg match against Aston Villa wey go shele tonight for Jan Breydelstadion.
Dis beta news fit make Super Eagles head coach, Eric Chelle, happy as e dey arrange im team for di important World Cup qualifiers wey go happen later dis month.