Nigeria don put life back inside dia 2026 World Cup qualification hope, as dem knack Rwanda 2-0 for Friday night.
Na di first match wey Super Eagles play under dia new coach, Eric Chelle.
Victor Osimhen no slow down at all, as e score two goals for first half.
Di striker wey dey shine for Galatasaray this season first score as e use hin leg tap in Ademola Lookman free-kick.
E come add di second goal after e thief ball for center field, con lob am over di goalkeeper head.
Di win don carry di three-time African champions go third place for dia group, afta South Africa knack Lesotho 2-0.
Chelle and hin boys go face Zimbabwe next for Tuesday.