Federal Government Don Reply Di Former Governor Of CBN Sanusi, On Economic Reform.

Federal Government Don Reply Di Former Governor Of CBN Sanusi, On Economic Reform.

Di federal government don react to di former Governor of di Central Bank and Emir of Kano, Muhammadu Sanusi II, over di economic reforms of President Bola Tinubu.

Sanusi tok for one statement during di, 21st memorial lecture of Chief Gani Fawehinmi for Lagos, say he go just dey observe di situation and e no go offer any economic advice to Tinubu government sake of say dem no dey act like friends.

Di former governor tok say explaining di reforms go only benefit di government, and he no wan help them.

Di Information Minister Mohammed Idris, come answer am for one statement say e dey disappointing say di Emir, wey first recognize di reforms, come dey condemn am quietly now because of change in loyalty.

Posted in News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *