Bollywood actor, Saif Ali Khan don go through surgery, after one unknown person stab am for him house over- night but e don dey fine and well.
Di attack happen early today for one good area inside Mumbai, for India, where Khan dey stay with him family.
City police tok say di actor get injury after one fight break out ,after one man wey no get identity enter e house after midnight.
Dem tok say Police don form team to investigate di matter.