Di Central Bank of Nigeria (CBN) don launch two new payment solutions, wey bi di Document Flow (DocFlow) System and di Ministries, Departments, and Agencies (MDAs) Naira Payment Solution.
Di announcement come from CBN governor, Olayemi Cardoso, for di launch wey happen for CBN Head Office inside Abuja.
Cardoso tok say this move na part of di Bank’s digital revolution project wey dem call “Digital First,” wey di Governor start in December 2023 as one of him transformation plans.
Cardoso bin explain say di DocFlow system go help improve how di Bank go fit manage documents by digitizing am, reducing paper use, and making approval processes easier.
Him also do tok say di MDAs Naira Payment Solution go automate cash withdrawal for MDAs, make financial transactions better, and improve client support.