Dr Muda Don Ask Federal Government To Provide Support For Country Economy.

Dr Muda Don Ask Federal Government To Provide Support For Di Country Economy.

Renowned economist, Dr. Muda Yusuf don ask di federal government say make dem provide support, including subsidies, for di power sector to help fast-track di socio-economic development of di country.

But e express concern about di current reform for di sector wey dey make Nigerians pay more for light, even with di economic hardship wey people dey face.

Dr. Yusuf tok these one during di NASFAT Business Breakfast 1.0, wey theme be  “Nigerian Economy: Di Hopes, di Slopes, and di Ropes; Empowering Professionals and Entrepreneurs” for Lagos.

Di former Director-General of di Lagos Chamber of Commerce and Industry  bin encourage SMEs to stay positive, sake of say talk say any business wey survive 2024 for Nigeria go likely survive for di following years.

Dr. Yusuf also call on di federal government to do something about di fluctuation for foreign exchange (forex), because e dey affect everything for di market.

Posted in News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *