Davido don vex because of fake headline wey link am to kidnappers.

Davido don vex because of fake headline wey link am to kidnappers.

One blog for X post video of three suspected kidnappers wey dem catch for Lagos, and dem use caption wey talk say, “Davido and two others apprehended for kidnapping in Lagos.”

Many fans confuse as dem think say di headline dey refer to di Afrobeats star.

Davido no happy with di misleading news and warn say e go take strong action against people wey dey spread false headlines.

E talk say one day, people wey dey do dis kind thing go face di consequences.

As e reshared di news, e write: “One day go be one day… Proceed. My karma no dey ever miss.”

Posted in Entertainment, Trending.