Nigerian football legend Jay-Jay Okocha don blast former Liverpool defender, Jamie Carragher, because of wetin e talk about Africa Cup of Nations (AFCON), say di Englishman no sabi appreciate African football.
For one interview wey dey circulate for X on Friday, Okocha talk say, “Some players go talk something, you go just overlook am. If you check dia career, if you see di kind football wey dem play, you go understand. I mean, you no go wan make your pikin be like Carragher. So, e no fit ever appreciate African football or di talents wey come from Africa.”
Okocha reaction follow di backlash wey Carragher don dey face afta e question di significance of AFCON as big tournament during Sky Sports post-match talk on Sunday, February 23.
Di discussion, wey involve Micah Richards, Daniel Sturridge, Roy Keane, and Carragher, bin focus on whether Mohamed Salah fit win di 2025 Ballon d’Or. Carragher talk say Salah no fit win big tournament, even though di Egyptian don reach AFCON final two times (2017, 2021).
But Richards and Sturridge quick challenge am, remind am say AFCON na serious competition. Di matter vex plenty people for social media as dem accuse Carragher say e dey disrespect Africa football.
Former Super Eagles captain, John Obi Mikel, sef no take am easy as e blast Carragher for him Obi One Podcast.
Mikel talk say, “AFCON big well well [like Euros]. I don play am, I don win am. E no be Carragher work to dey discredit AFCON. E go sit down every week dey teach people how to win Premier League, but e never even win am before!”
Di ex-Chelsea midfielder, wey win AFCON for 2013 with Nigeria, talk say di tournament dey inspire young African footballers.
“Children dey grow up dey watch dia idols play for dia country,” Mikel talk. “Di way African players dey enter Premier League and Europe today, na because dem grow up dey watch African Cup of Nations.”
Mikel Obi, wey enjoy beta career for Chelsea, win two Premier League titles, four FA Cups, one UEFA Champions League (2012), and two UEFA Europa League trophies.