Kogi Central Concerned Stakeholders Don Comot Hand from Senator Natasha Matter

Kogi Central Concerned Stakeholders Don Comot Hand from Senator Natasha Matter

Kogi Central Concerned Stakeholders don talk say dem no get hand for di wahala wey dey shele between Senate President, Godswill Akpabio, and Senator Natasha Akpoti-Uduaghan.

Di group still talk say dem no happy as Senator Akpoti-Uduaghan no follow di Senate standing rules.

For di statement wey di group convener, AbdulRaheem Adeku, sign, dem even threaten say if di senator continue di gbas gbos, dem fit begin process to recall am.

Di statement talk: “As government institution wey get respect, e no get how person go talk say National Assembly no get standing rules wey dem must obey to keep order, but we dey regret say wetin suppose be small mata of compliance to rule don turn attack against di Senate President, Godswill Akpabio.

“Even as we sabi di support wey di Senate leadership don give Senator Natasha for di past few months, we wan clear say we no dey support di way she dey behave.

“We expect Senator Natasha to sabi say she be equal to other members of di Red Chamber, make she behave well, focus on di work wey her people send her go do, and stop to dey bring distraction wey no go help anybody.

“As Kogi Central people, we be people wey dey show gratitude, loyalty, and respect for friendship.

“We no go gree for di actions, talk, and smear campaign wey our daughter dey do against di Senate President, Godswill Akpabio.

“No be our way be dis, so if she continue to dey abuse di privilege of representation for Senate, we Kogi Central Concerned Stakeholders fit start di process to recall am.

“As we dey pledge our total support and loyalty to di Senate President and all di Senate members, we dey also call di Senate make dem continue with di disciplinary action wey dem don start, so e go serve as example for other senators.”

Posted in News, Politics, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *