Four Pipo Don Die For Lagos-Ibadan Expressway Accident

Four Pipo Don Die For Lagos-Ibadan Expressway Accident

Ogun State Police Command don confirm say four passengers don die for one accident wey happen for Lagos-Ibadan Expressway.

Police tok-tok pesin, Omolola Odutola, talk dis one for statement wey dem issue for Abeokuta, wey be Ogun State capital. She come add say other pipo wey dey inside di bus woundjure for di accident.

She talk say di accident happen for Sunday night for Alapako area, inside Obafemi Owode Local Government Area.

Di accident na only one motor dey inside, one Toyota Hiace wey get registration number FKJ570YE. Police say na tyre wey burst cause di wahala, wey make di driver lose control of di motor.

“As di accident happen, four pipo, including di driver, just kpai for di spot, while nine other passengers woundjure. Di bus sef spoil well-well because of di crash.

“Police bin dey di scene to help control traffic, make pipo no gather too much, and dem do video recording plus documentation.

“Dem rush di pipo wey wound go Victory Hospital for Ogere make dem treat dem, while di dead bodies don dey FOS Mortuary for Ipara for autopsy,” di police tok.

Di Command don still beg motorists make dem dey check dia motor well before dem drive, and make dem follow road safety rules so accident no go too plenty for road.

 

Posted in News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *